The whole World dey on lockdown because of the Coronavirus wey dey spread like wild fire. Football lovers dey without their favorite sports and most celebrites dey use their social media handles to raise awareness for the ‘Stay At Home Campaign’.

One of the Celebrites wey dey do well in Nigeria na Odion Ighalo. Aside the fact say e dey shine at Manchester United, e also don donate foodstuff to charity during this period. E dey also share money online for people wey no get, so dem go fit stock up for the ‘Stay At Home’ Period.

Odion Ighalo dey try both for inside pitch and for outside. For pitch, e don shine at Manchester United. E don play eight games for the Red Devils. E don start three, e get four goals and one assist. The Reds dey reason whether dem go make hin stay at Old Trafford permanent. E be like dream because when Man United announce am, many people bin dey mock am as dem dey expect the 30-year-old to flop but e don prove them wrong.

Ighalo inside dem training for Manchester United

 

However, we bin look say SkySports don confirm say Ighalo’s parent club Shanghai Shenhua, wan pay am £400,000 per week so e no go stay for United permanently. Like play like play, Jude Ighalo don turn hot cake.

Whether Ighalo stay or leave when season finish, e don already make hin mark at United and fans go respect am. No be beans to be the first Nigerian to play and score for Manchester United. ​

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *