The coronavirus dey affect football wella. Yesterday, the FA talk say dem go suspend all competitions (Premier League, FA Cup, etc) till 4th April. Dem bin do meeting after Arsenal coach Mikel Arteta test positive to the virus. 

No Manchester United don test positive to the virus but the koko na to prevent the spread of the virus, na why dem suspend the league. 

We also fit confirm say UEFA don postpone the Europa League games wey suppose happen next week because of the virus. 

We hope say the League go return on 4th April but we dey fear say e no go happen as dem fit cancel the League if more people test positive to the virus before then. 

Manchester United midfielder Paul Pogba dey use hin social media platform to spread awareness for the corona virus. 

Lastly, we dey advice make everybody stay safe. 

 

Thank You,

Ugo MUIP 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *