Na no suprise to us and many United fans when Bruno Fernandes win PFA Premier League Player of the Month for February, as we believe say e deserve am.
Since wey Bruno Fernandes wakka enter the club, e don get 3 goals and 3 assists in hin 8 games for the club. Also, the Red Devils don win 5 out of the 8 games, dem draw the other three.
Before the Portuguese international bin enter United, the Reds bin dey rotate between Jesse Lingard and Pereira for No.10 role. As Jessie and Pereira no dey form, the Reds bin dey struggle to break teams down, na why dem drop many points. As Bruno show, e get key wey fit unlock any defence. Hin assist to Anthony Martial for the goal against Manchester City on Sunday na perfect example to wetin e fit do.
Many United fans still dey look forward to the return of Paul Pogba as dem don dey imagine how midfield of Pogba and Fernandes go be. We believe say if dem two link up well, dem go blow Premier League teams away.
Right now, Manchester United three points behind Chelsea wey dey fourth position for Premier League table. The next game for the Reds na against Tottenham. The Red Devils go dey count on another masterclass from Bruno Fernandes to unlock Spurs defence.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *