Tottenham striker Harry Kane dey eye move to Manchester United, na the reports wey we dey hear from the media.

According to goal, the 26 year old England international no dey enjoy life at Tottenham and e no wan stay at the club when dem wan rebuild.

The club dey struggle to qualify for Champions League and dem dey without Harry Kane because e get hamstring woundjure. Also, Heung-min Son don break hin hand. The South Korean forward fit miss the rest of the season and the club don send am home so e go do surgery for hin hand.

Right now, Spurs no get striker and the only good player wey dem sign for January transfer window na Steven Berwijn.

Kane don clear Tottenham say e wan relocate to Old Trafford when summer reach. Hin price tag go be over £100 million, as hin contract dey expire in 2024.

Man United don write out list of all the people wey dem wan sign. Some of the players wey dey top the list na Jack Grealish and James Maddison from Leicester City. The Red Devils dey also eye Jadon Sancho from Borussia Dortmund.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *